Thursday, December 13, 2018

Comedy Sextion - WHO WAN DIE?


One police officer wey dey for duty for road, stop one driver with his moto, dis na di things wey di two of dem talk about.

Police: Paaarrrk! Wey your party-coolars?

Driver: Na him be dis.

Police: Dem no complit ooh

Driver: Oga supo, make u check am well na, evri complit ooh.

Police: Shebi u wan teach me my work na abi? Even sef wia u dey come from dis cain time?

Driver: Na from burial oga supo

Police: Na who die?

Driver: Na one Policeman die ooh

Police: Eya! Nawaooh, na wetin kill am na?

Driver: Na becos of juju moni wey him collect from one driver for check point, him hand come                      swell-up, from there he come die.

Police: D policeman na your friend or your relative?

Driver: No sir

Police: Na wetin con concern u? Wetin u go do for di burial?

Driver: Na me be di native doctor wey do di juju, so I go remove di money from di dead man hand.
             (Dis moment, di police officer dey look me with one cain eye)

Driver: Oga supo, I beg u, I don tire welwel, make I find u small tin make I dey go my way jor.

Police: Listen we police na your friend, we no dey collect bride ooh, oga u fit dey cane your line dey              go jare, drive safe ooh.

Nor be small tin ooh, oga police refuse to collect di normal egunje wey dem dey always dey collect ooh....na who wan die?

No comments:

Post a Comment