As 9ja presido election don dey near so, mani pipo don dey rush dey go collect dia PERMANENT VOTERS CARD (PVC) from di places wey INEC talk say make dem go take am.
One 9ja citizen wey him name na Ugiagbe Peter, him don dey beg everi bodi say make dem nor make mistake go vote for di wrong pipo ooh. In fact him talk say make Nigerians vote for di person wey he don get gud track record to do sometin, and he say di person wey go fit bring electricity, gud road, better train, better hospital and plenty oda gud tins for di contri, he say dat candidate na OMOYELE SOWORE wey dey run from di party wey dem dey call AFRICAN ACTION CONGRESS (AAC).
Di 9ja pikin talk say him dey beg all papa, mama, broda and sista, say on di ogbonge day 16th February, 2019, make all of dem show face for everywhere to vote for OMOYELE SOWORE and all other AAC candidates.
(adsbygoogle = window.adsbygoogle || []).push({
google_ad_client: "ca-pub-7494374139340390",
enable_page_level_ads: true
});
Friday, February 8, 2019
PIDGIN NEWS - One Broda Don Tell 9ja Pipo Say Na Omoyele Sowore Fit Do Work
Labels:
News,
Pidgin News
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
(adsbygoogle = window.adsbygoogle || []).push({
google_ad_client: "ca-pub-7494374139340390",
enable_page_level_ads: true
});
No comments:
Post a Comment